peace olisa
President Muhammadu Buhari giving marching order on Friday night afta e meet Inspector General of Police (IGP) ontop #EndSARS Buhari meet IGP ontop #EndSARS protest across Nigeria.
“Our determination to reform di police make e no dey in doubt. I dey briefed regularly on di reform efforts ongoing to end police brutality and unethical conduct, and ensure say Police are fully accountable to di pipo.” Buhari tok.
Di Nigerian leader meeting wit di police chief dey come afta two whole days of protest wey staet for Lagos and spread across di kontri since Wednesday dis week.
#EndSARS become di number one Twitter trends on Friday around di world sake of wetin dey happun for Nigeria.
For Nigeria, some social media users dey even post #BuhariResign sake of di #EndSARS protest across Nigeria.
Di president say di IGP already get my strong alias firm instructions to finally address di concerns of Nigerians regarding di plenti anyhow behaviour alias excesses of SARS officers and ensure say officers wey commit face justice.
President Buhari for message e post ontop im official social media page beg for for patience & calm, even as Nigerians freely exercise dia right to peacefully make dia views dey known.
Di plenti majority of men and women of di Nigeria Police Force believe in Nigeria alais dey patriotic and committed to protecting di lives, property and area of Nigerians, and we go continue to support dem to do dia job, President Buhari add.
Nigeria inspector general of police bin don ban di unit from doing stop and search duties and setting up roadblocks on Sunday 4 October as tempers boil sake of everiday harassment and police brutality wey many claim say na SARS officers dey commit.
IGP Mohammed Adamu also tok say members of the Special Anti Robbery Squad (Sars) must always wear uniforms but Nigerians want Sars to end completely so dem enta road do protests across di kontri.
Details later.
As Nigerian youths enta road dey shout end sars, President Muhammadu Buhari receive briefing from National Security Adviser Maj. Gen. Babagana Monguno (Rtd), wey Coordinator Presidential Amnesty Programme Col. Milland Dixon Dikio (Rtd) escort to State House, Abuja on Friday.
Wetin be di background to di latest palava?
For years, videos wey appear show SARS officers extorting and assaulting civilians don spread for social media.
Last weekend Nigeria inspector general of police bin don ban di unit from doing stop and search duties and setting up roadblocks
Tori be say Nigerian youths and celebrities dey demand goment to completely ban police unit- Special Anti Robbery Squad wey dem accuse of many brutality.
Content Source: https://www.bbc.com/pidgin/54487651
Get involved!
Get Connected!
Come and join our community. Expand your network and earn money and also get to know new people!
Comments